描述
No Fall Mugu – Cybersecurity Na For Everybody! My people, make una hear word o. This internet wey we dey use—na blessing, but e fit bring yawa if you no shine ya eye. If dem send you text message or wosup say “You win 1 million,” or “Click here make your accant no block.” Na job! No bank go ever ask you for PIN or password like dat.. If pesin send you link wey you no know, no click am. If call enter wey dey rush you say make you send money, abeg cut the call. If dem say make you send code wey enter ya phone, lock up. Even if you no go school, you fit still surji. Dis online mata no be for only pipo wey wear agbada. If you no sabi, ask pesin wey sabi. No shame to learn o! Make we no dey jones awasef. Internet palava dey real. Shine ya eye, protect ya phone like ya pikin, and no allow anybody use ya head. Cybersecurity na for everybody. Stay safe! This message na from Ododoobari John Okpabi, wey dem dey call Big OJ—your cyber guy wey wan make all of us dey safe.